Monday, January 6, 2020

HOUSING: See How Much You Fit Use Build House For Nigeria







Bungalow
Image example'5 million naira fit build you three bedroom bungalow'



One dream of evri Naija pesin na to build im own house so im go stop to dey pay rent sake of say rent money too high for di kontri.


Nigeria, di kontri wit di most population for Africa, get about 3 million pipo witout beta house.


Dis housing shortage dey contribute to high rent rate wey di kontri pipo dey experience.

To rent three bedroom flat for beta areas inside major cities, pipo dey pay between one million Naira (about 3,000 dollars) to 10 million Naira (about 27,000 dollars).


Building experts tell BBC say, depending on which part of di kontri wey you dey, you go fit use five million Naira (about 13, 000 dollars) build three bedroom bungalow for Nigeria if you don already get land.